45-year-old housewife allegedly kill her 14-year-old housemate
Jigawa police command say dem don arrest one 45-year-old housewife, Who dem allege say poison her 14-year-old housemate to death, Zulfa'u Amadu, For Kangan village wey dey Taura local government area.
The command PRO, Superintendent Jinriri Abju, Confirm the news to tori people, Say, For May4, The suspect prepare afternoon food wey her family wan chop and come put rat poison for Zulfa'u's (The deceased) own share of food. The PRO also add join say this bad thing happen six days after Zulfa'u's take marry her husband, Malam Amadu.
According to report, After Zulfa'u's eat her food, She come begin dey roll for ground, Dey hold her belle in pain and as people dey rush her go hospital na she die for road.
However the suspect wey be the senior wife to Malam Amadu, Don deny the matter, She say, she nor get hand for wetin police people dey accuse her of, She say, Na she and the deceased gather chop together for the same plate, Say she nor put any poison for the food at all.
The PRO come finally tell tori people say them don carry from the sample of the food go for medical analysis, According to ham, The body of the deceased don reach her family people for burial, The PRO say dem go charge the suspect to court after dem don conclude their investigation.<a href="http://www.GistQK.blogger.com>your number 1 pigin bloging site</a>

Comments
Post a Comment