Journalist found in ''pool of blood'' dead
People don find one female journalist dead body for inside her house, For Mexico with knife wounds for her back of neck. The state attorney general office talk say, Na Alicia Diaz Gonzalez, 52, (The deceased) children find her body and them dey upstairs at the time the incident happen, But nor come hear any sound or struggle.
Dem say the woman body lie down for ground with her face downward for pool of blood after many stab wounds. Dem also confirm her death for her working place, Where she dey work as Journalist since January. The editor for there, Mauricia Mejia don call for the ''urgent''.....Official response'' about the matter for social media.
Authorities never still come up with wetin cause the assassination. The deceased colleagues for work tell tori people say, Diaz's (the deceased) dey only report local business and financial issue news, And nor dey report tough tori matter like drug trafficking wey go fit cause assassination.
But, The National Human rights commission don tell authorities dem to focus their investigation for Diaz's line of work.
According to report, Dem say last week dem still assassinate another Journalist, Juan Carlos Huerta, Carlos comot for house and dey go somewhere, When the assasin shot ham.
Mr Carlos murder happen just one year, After Javier Valdez wey be top reporter for drug trafficking matter also die, Dem shot Javier for broad day light for him native home Culiacan, Sinalra, The place wey dem say bad gang dey operate.
With all of this bad things wey dey happen for Mexico, The country don become one of the most dangerous place in the world for Journalist, With the record of about more than 100 reporters dem don kill for there since 2000. And till today most of the crimes still dey. ground.

Comments
Post a Comment