(STREET/PIGIN REPORT) COURT JAILS WELDER 3YEARS FOR STEALING N,17,000 CELL PHONE.
One Yaba Chief Magistrates' Court wey dey for Lagos, Don on Wednesday sentence one 23-year-old welder, Emmanuel Ibrahim, To 3years imprisonment, After him thief phone wey worth N17,000.
The Chief Magistrate, Mr P.A.Ojo, wey sentence Ibrahim after e don plead guilty to the offence, Talk say the convict (Mr Ibrahim) go serve him term for prison without any fine.
Mr Ojo also add say, This sentence go serve as lesson to any other person wey go wan like indulge in this kind of crime.
The prosecutor, ASP Roman Unuigbe, Tell the court say the accused commit the offence on May17, at 4.00pm for Anifowose Street, For Shomolu area of Lagos.
He say Ibrahim snatch the phone from the owner (Complainant) fatimo Atanda, When she dey use the phone make call for street, But luck nor come dey him side as passersby come catch ham, After the owner (Complainant) raise alarm.
Mr Unuigbe (The prosecutor) come later finish him report, Say after people recover the phone from Ibrahim, Them come later hand over the phone to Police.
Ibrahim be beg the court wey them abeg temper justice with mercy, He say he thief the phone before, So he go fit sell ham and use the money take feed himself.
WHAT DO YOU THINK ABOUT THE SENTENCE, WAS IT TOO HASH OR WAS IT FAIR, PLEASE LEAVE YOUR COMMENT, SO WE CAN DISCUSS.

Comments
Post a Comment