(STREET/PIGIN REPORT) WIFE BEG COURT TO END HER MARRIAGE AFTER SHE DISCOVERED THAT HER HUSBAND IS A THIEF.
one 35-year-old woman, Remilekun Familusi, Don tell one Abeokuta Customary Court to abeg end her Marriage with her husband Olayinka, Because say he dey thief. she tell the court say, She don already born one pikin for ham, Remilekun say her husband dey thief and dupe people, And them dey always declare ham wanted. She also add say, Her Husband dey always steal baby food and provisions from supermarket and go bring ham come house for her to take feed their pikin, She say she don tell ham to stop all this him bad habit of stealing, But he nor gree dey listen to her. She still go further say her papa don first bail her husband Olayinka comot from police custody, Before she come finally comot from her husband place, She say the arrest happen when her husband steal laptop from Guarantee Trust Bank (GTB) for one of the branches for Abeokuta. She come finally end her talk say, Wey the court abeg dissolve her union with her husband, Say she never for once don experience anything l